Wetin be Manual Vacuum Aspiration (MVA)?
Manual Vacuum Aspiration (MVA) na very safe method of abortion for belle wey don reach up to 14 weeks. Dem dey do MVA inside clinic or hospital and na health care person wey sabi na im go do am.
When you dey do Manual Vacuum Aspiration (MVA) the clinic person go use instruments, like silent suction device, to commot the belle from the uterus. Most times, dem dey use local anesthesia for dis procedure while the woman go dey awake, and e dey take like five to ten minutes. After, the woman fit go house.
The woman fit experience cramping when dem dey do the procedure, and bleeding fit dey on and off for plenty days or weeks after. [1]
[1] “Clinical updates in reproductive health.” Ipas, 2020, www.ipas.org/wp-content/uploads/2020/08/ClinicalUpdatesInReproductiveHealthCURHE20-English-digital.pdf. Accesed November 2020.
During MVA Abortion FAQ
- Wetin be the Success Rate for Manual Vacuum Aspiration (MVA) abortion?
- Manual Vacuum Aspiration (MVA) Abortion Dey Pain?
- Wetin be the Side Effect of Manual Vacuum Aspiration (MVA) Abortion?
- Surgical Abortion Dey Safe?
- Wetin be the time for the Different Method?
- Wetin be Induction Abortion?
- Wetin be Dilation and Curettage (D&C)?
- Wetin be Dilation and Evacuation (D&E)?
- Wetin be Electric Vacuum Aspiration (EVA)?
- Wetin be Manual Vacuum Aspiration (MVA)?
- Wetin be the risks and complications wey fit happen for vacuum aspiration abortion?
*Nothing provided herein should be construed as professional medical advice and no medication / pills should be used without a prescription from a licensed / registered medical practitioner eligible to prescribe such medication in your local jurisdiction.