Wetin be Dilation and Evacuation (D&E)?
Dilation and Evacuation (D&E) na safe method of abortion wey dem dey use well well for belle wey don pass 14 weeks gestation. For D&E, dem go soften the cervix with some kain agents to help am dilate. is softened with agents used to help with dilation. Person go need take dis agent plenty hours, or even days sef, before the procedure. Na clinic person wey sabi go use different instrument and Electric Vacuum Aspiration (EVA) to take commot the belle. Dem fit use ultrasound during the procedure. E Depend on how long the belle don stay, dem fit use local anesthetic or sedative medicine to take reduce discomfort for the woman during the procedure.
Na the law about abourtion for different places for the world na im go determine if D&E go dey available. For some places, D&E fit dey available for women who wan do abortion for any reason, or e fit dey for women who need abortion because of health matter. [1]
[1] “Safe abortion: technical and policy guidance for health systems.” World Health Organization, second edition, 2012, www.who.int/reproductivehealth/publications/unsafe_abortion/9789241548434/en/. Accesed November 2020.
During MVA Abortion FAQ
- Wetin be the Success Rate for Manual Vacuum Aspiration (MVA) abortion?
- Manual Vacuum Aspiration (MVA) Abortion Dey Pain?
- Wetin be the Side Effect of Manual Vacuum Aspiration (MVA) Abortion?
- Surgical Abortion Dey Safe?
- Wetin be the time for the Different Method?
- Wetin be Induction Abortion?
- Wetin be Dilation and Curettage (D&C)?
- Wetin be Dilation and Evacuation (D&E)?
- Wetin be Electric Vacuum Aspiration (EVA)?
- Wetin be Manual Vacuum Aspiration (MVA)?
- Wetin be the risks and complications wey fit happen for vacuum aspiration abortion?
*Nothing provided herein should be construed as professional medical advice and no medication / pills should be used without a prescription from a licensed / registered medical practitioner eligible to prescribe such medication in your local jurisdiction.